Euphoria and Grey's Anatomy star Eric Dane don reveal say dem diagnose am wit amyotrophic lateral sclerosis (ALS), wey be di most common form of motor neurone disease (MND).
Di 52-year-old actor wey tok to People say im dey "grateful to have my loving family by my side as we navigate dis next chapter".
"I feel fortunate say I dey able to continue to work and am look forward to return to set of Euphoria next week," e add, and ask for privacy for imsef and im family.
Dane act as di Jacobs family patriarch Cal Jacobs on hit HBO teen drama show Euphoria, wey dey expected to begin production on season three on Monday.
E also play Jason Dean inside fantasy drama series Charmed, and Captain Tom Chandler for action drama show The Last Ship, while appearing inside feems such as Marley & Me, Valentine's Day and Burlesque.
Dane dey married to actress and model Rebecca Gayheart, and dem get two children togeda.
Wetin be ALS?
According to di NHS, MND "get several different conditions wey dia common feature na di premature degeneration of motor nerves (known as neurons or sometimes neurones)".
Dem say nearly 90% of patients wit MND get di mixed ALS form of di disease.
ALS, also known as Lou Gehrig's disease, na rare degenerative disease wey dey cause progressive paralysis of di muscles
atients go first experience twitching or weakness in dia limb, ofta dis, dem go dey tok as if dem dey drag dia speech (slurred speech)
Di disease dey affect di nerve cells inside brain and spine wey dey control muscle movement, and dis dey cause patients to slowly lose dia ability to speak, eat, walk and breathe independently
ALS no get cure, and, according to di Muscular Dystrophy Association, pipo usually live for three to five years afta diagnosis, although some fit live for decades
No comments:
Post a Comment