director

US President Donald Trump don appoint podcaster and commentator Dan Bongino as deputy director of di FBI.
Trump post on social media say Bongino na "a man of incredible love and passion for our kontri" and im go serve under new FBI Director Kash Patel wey dem just confam.
Bongino, wey dey 50 years, bin don work for di New York police department and di Secret Service, na Trump ogbonge padi wey bin push false claims about di 2020 election and oda stories.
Im appointment, wey no need Senate confirmation, mean say none of di top two pipo wey dey run di agency get FBI experience.
Di deputy director, wey dey responsible for supervising all domestic and international operations, dey usually be a career agent wit years of experience.
Bongino dey host di daily podcast Di Dan Bongino Show wey im Facebook posts dey get more attention dan di ones wey Fox News and CNN dey post togeda evriday.
For Friday episode, e get one segment about di FBI, wia im bin praise Patel and bin try to remove di Democratic fears say Trump go use di agency to target im enemies.
"Kash Patel dey dia for one reason, im dey dia to make di FBI great again," im tok.
Im dey committed to fighting crime and only crime, im add, as im call im new boss di "change agent" wey di FBI need.
"How amazing e go be in four years to look back wit a good, high-quality, reformed FBI free of woke culture and DEI wey dey go out to make headline, big arrests of real bad guys wey dey destroy your community. How good e go be?"
Trump tok for im social media announcement on Sunday say Bongino fit give up di podcast, im add say im go help restore fairness, justice, law and order.
Bongino, wey bin don contest for Congress three times, bin host Trump for im podcast ahead of last year election.
Episodes of im programme from last week include titles like "Trump Keeps Delivering And The Libs Are Seething" and "The Only People Who Love Crime Are Criminals!!!"
Im don repeat Trump false claim say im bin win di 2020 election and push forward anoda conspiracy say Joe Biden administration bin dey behind di FBI search for classified documents for Trump house for Florida.
"EVERYONE wey bin dey involve for di DOJ/FBI abomination, from di management down to di agents, must be immediately terminated wen dem throw out di tyrants from office," im tok on X.
For 2018, wen im bin dey tok about im career as ogbonge conservative political commentator, Bongino say: "My life dey all about owning di libs now."
Dem dey see as im dey fire back at Trump critics on X, including one long-running mata wit horror author Stephen King.
Na last week dem narrowly confam Patel for Senate to lead di law-enforcement agency wey im don dey attack for long.
Im deny any plans to pursue political vendettas and im also promise to "rebuild" di bureau.
No comments:
Post a Comment